Drama don finally cool down for Peller house o!
The TikTok star don come out to explain why he sharply settled him and him wife Jarvis after their fight went viral.
According to Peller, na fear of prison make am humble quick!
He say make una remember wetin lawyer talk for him wedding? The lawyer talk say if he divorce him wife, dem go carry am go prison for 5 years!
Peller shout say, “Una wan put me for trouble? If dem throw me inside prison, una go forget me for there o! Abeg I no want go jail. I don beg my wife, we don settle. I no want chop prison beans o!”
Omo! 😂 Fear of prison beans don make Peller turn to humble husband instantly.
So for now, Peller and Jarvis don settle, no more divorce. Prison beans no go catch anybody!